Fela Kuti

Fela Kuti - Power Show lyrics

Your rating:
I open my eye I see for my land 
*(CHORUS) NA WRONG SHOW O 
Everywhere you go 
Everywhere you dey
Everybody want do power show 
Na wrong show O
You reach boarder immigration 
officer dey 
Him go bluff you 
Waste your time 
Change him pants 
Some dey comb dem hair 
Den tidy dem table 
Den dem pull dem chair 
Before him go know say you dey there 
If you no talk quick 
Him go go for shit 
Him go shit come-back 
And you talk to am 
Then you suprise when him 
Shack for you 
Him go say you no go cross 
You no go cross today 
Na that time dem go start Dem 
Power Show O O 
Na wrong show 
Go post office na the same 
Dem go bluff you 
Waste your time 
Run you up 
And then run you down 
Dem go tire your body 
And then tire your mind 
And them tire your whole mind 
Dem go say no change for fifty Kobo 
Na that time dem go start them 
Power Show O O 
Na wrong show O 
Motor car owner sef him go take 
him car push him car push laborer 
Down for road 
Then him start to yab 
Foolish labourer 
Nonentity, him no get money 
Look him sandals e don tear finish 
Look him trouser e don tear for yansh
Look him singlet e don dirty finish 
Look him body e no bath this morning 
Look him pocket e don dry finish 
You go suffer for nothing 
You go suffer for nothing 
You no know me sha? 
I be General for Army Office I 
I be Officer for Police Station 
I be secretary for government office 
You foolish laborer, Nonentity,
you go suffer for nothing 
Na that time dem go start dem 
Power Show 
Na wrong show O
Power Show 
Na sad thing 
Na bad thing 
Na wrong show O 
Power na to help your land 
Na to help your mates 
Na wrong show O
Get this song at:
bol.com
amazon.com

Copyrights:

Author: ?

Composer: ?

Publisher: ?

Details:

Language: English

Share your thoughts

This form is protected by reCAPTCHA and the Google Privacy Policy and Terms of Service apply.

0 Comments found